Na who wan kill Govnor Nyesom Wike?

“So, you de tink say di federal govment wan kee you?”, na the kweshun wey, Cletus Ukpong, wey de work for Premium Times ask Rivers Govnor, Nyesom Wike for interview. When Wike go come answer Cletus kweshun, hin talk say, “e dey obvious”.

Dis one no be di first time wey Wike go talk say di federal govment and security pipo dey plan to kill am.

For Disembaa 2016, the govnor shout say the oga patapata for police, Ibrahim Idris, use hin power take commot hin Chief Security Person on top say de wan perfect di plan to kill am. But the mata no end for dere, as Wike padi, wey be Ekiti govnor, Ayodele Fayose, talk say, wetin Idris do as hin commot hin padi  police bodyguard na proof say police wan kill Wike tru tru.

For January 2017, Police talk say e don sack six of deir pipo wey de work for the govnor on top say de do some kurukere waka for one election wey happen for di state. Don Awunah, who be di talk talk person for Police wen di ting happun talk say, “Dese police pipo gum body di govnor convoy on di day wey di election happun, December 10, 2016, come dey use di gun wey de deir hand anyhow, wey no dey in line with di provisions of Force Order 237. Di officers come dey do gra gra, come fire dier gun, wey come dey make pipo dey fear.”

But, Wike no gree with wetin di police talk talk person yarn. “Dem remove di police pipo bcos dem no allow di security pipo to kill me as dem do plan am,” Wike talk. The govnor come add say “the security pipo plan to kill am but the policemen wey den hin side no allow dem. Na wetin come make dem dey para and vex.”

For April 2017, Wike talk say Zaki Ahmed, wey bi the oga patapata for police for di state don collect origo informate from Oga Idris to kill am. “Dey talk say dem go kill me,” Wike yarn. “Dis police oga get plan; dey no fit deceive me. I no dey talk say make hin go, make hin remain. Dem don give am order to kill me. No wahala. No person fit die two times.” The police no gree with wetin di govnor talk, dem say Wike no fit prove wetin hin den yarn. “No time de wey, even for now, and even before, wey oga IGP tell di Commissioner of Police or police pipo for anywhere for di country make dem kill Hin Excellency, Barrister Nyesom Wike.”

E never too tey wey police talk say di govnor no get point, na hin Wike, who de follow journalists yarn for Port Harcourt, come talk again say the IGP wan kill am. Di Rivers State govment come release statement on top di mata, wey dem yarn say, di govnor escape pipo wey wan kill am, five times for eleven months. Di person wey bi State Commissioner for Information and Communication, Dr Austin Tam-George talk say some pipo bin wan offer two of the six police pipo wey dem sack one hundred and fifty million Naira, make dem fit kpai di govnor, but di policemen no gree accept di money.

Fayose, wey bi Wike padi padi and who don bi di number one person wey dey trouble oga president and di party wey dey for power, di APC, don talk say di police wan kill am before. Fayose, talk dis ting, wen hin de talk for PDP rally for di Ekiti govnorship election. Hin talk say the police oga wen dey in charge of Mopol don receive order to kill am. Fayose talk dis wan after hin don accuse police pipo say dem beat am and throw teargas for hin eye.

E be like say Wike don enter wetin oyinbo de call paranoia. Hin paranoia with di federal govment and security pipo na real problem and no dey difrent from wetin Senator Dino Melaye de do, wey hin de accuse police pipo and Kogi govnor, Yahaya Bello, say, dem wan kill am. E bi like say Wike de do all dis ting make hin supporters come dey pity am.

Wetin you think about this mata wey Wike dey do?

Leave a reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

cool good eh love2 cute confused notgood numb disgusting fail